https://www.bbc.com/pidgin/articles/c4gv5de1l6jo.ampPresident Donald Trump dey face calls to launch full investigation following di fatal shooting of 37-year-old nurse, and US citizen, Alex Pretti by federal agents.
Pretti death bin come less dan three weeks afta one immigration agent for Minneapolis shoot to death Renee Good.
Minnesota Govnor Tim Walz don repeat demands for di Trump administration to remove federal agents from di state. E say US dey for "inflection point".
For one interview wit di Wall Street Journal on Sunday, Trump tok say im administration dey "review evritin" and also indicate say im go eventually withdraw Immigration and Customs Enforcement (Ice) agents from di city - but e no give time frame for dis.
Federal and state officials don give totally different accounts of di moments bifor Pretti death.
Di Trump administration defend di officer wey shoot Pretti. Homeland Security Secretary Kristi Noem tok say dem shoot Pretti bicos e dey "wave" one gun.
Local authorities deny dis. Dem say di gun dey legally registered, dem say di agent shoot Pretti afta dem remove im firearm.
Protesters don continue to enta di streets of Minneapolis plus oda parts of di US following di fatal shooting.
Meanwhile, di Republican Govnor of Vermont, Phil Scott, tok say e no "dey acceptable" for "federal agents to kill US citizens" for exercising dia protected rights to protest.
E dey among some of di Republican lawmakers wey dey call for full investigation into di fatal shooting of Alex Pretti.
E say, "at best", immigration officers actions na "complete failure of coordination of acceptable public safety".
"Enough dey enough."
"Di president suppose pause dis operations, de-escalate di situation and reset di federal govment focus on truly criminal, illegal immigrants," e write and add say, "Congress and di courts gatz step up to restore constitutionality."