β16618[Quote]
https://www.bbc.com/pidgin/articles/cj411r4y9n7oUnited States President Donald Trump don threaten possible military action for Nigeria as e accuse di Nigerian govment say dem allow di killing of Christians.
Dis dey mark a dangerous escalation for di US claims of mass killings of Christians by jihadists wey fit affect di relationship between di two kontris.
Di Nigerian govment don reject di claim say Islamist insurgents for di Muslim majority north of di kontri dey target Christians.
Trump for im Truth Social on Saturday 1 November say Washington fit "go in guns-a-blazing to wipe out," wetin e say na Islamic terrorists wey dey commit atrocities.
Di US President bin refer to Nigeria a 'disgraced kontri' and di USA go move to 'wipe out' terrorists.
E also threaten to stop all aid and assistance to Nigeria. "I dey hereby instruct our Department of War to prepare for possible action. If we attack, e go dey fast, vicious, and sweet, just like di terrorist thugs attack our CHERISHED Christians!" Trump tok, and warn say di govment beta move fast.
β16619[Quote]
On Friday Trump bin announce say e don designate Nigeria as "Country of Particular Concern." Di Nigeria govment bin respond on Saturday and deny say Christians bin dey targeted.
President Bola Tinubu while reacting to di designation by Trump, explain say Nigeria dey deal wit insecurity wit pipo of both faiths wey dey suffer di violence. E note say Nigeria constitution allow freedom of worship.
"We remain committed in our resolve to tackle di violent extremism wey dey fuelled by special interests wey don help drive such decay and division for kontris across di intersecting West African and Sahel regions," di govment tok.
Tinubu tok say di US na close ally, and say im govment go maintain im laser focus and steadfast commitment to all partners wey believe in genuine peace, stability, freedom and democracy.
Di designation of "kontri of particular concern" na one of di most serious labels Washington fit apply under US law. E dey allow for sanctions or oda diplomatic measures against nations accused of severe violations of religious freedom.
For long, Nigeria don face religious and ethnic tensions, particularly for di northeast, wia Islamist groups such as Boko Haram and Islamic State West Africa Province don carry out deadly attacks for more dan ten years.
For central Plateau and Benue states, northcentral Nigeria, hundreds of pipo don die inside farmers and herders clashes.
Human rights organisations say both Christian and Muslim communities don suffer from di violence, though some groups accuse authorities of failing to protect minority populations.
Di last time di US Department of State designate Nigeria as "kontri of particular concern" na for December 2020 for reportedly engaging in or tolerating severe violations of religious freedom under di International Religious Freedom Act.
β16620[Quote]
US fit invade Nigeria?
Di tok of if di US fit invade Nigeria dey debatable and e don raise many questions among Nigerians.
According to di Constitution of di United States, section 8 say di Congress get di power 'to declare War, grant Letters of Marque and Reprisal, and make Rules wey concern Captures on Land and Water.
According to di United Nations Charter, na di Security Council fit determine and decide which kain measures dem fit use to restore peace for any international kontri.
Article 39 of di Charter say "di Security Council go determine di existence of any threat to di peace, breach of di peace, or act of aggression and go make recommendations, or decide which measures dem fit take in accordance wit Articles 41 and 42, to maintain or restore international peace and security."
Di UN no support di use of force on anoda kontri unless na for self-defence.
Meanwhile, for one speech titled 'di Legal Framework for di United States' Use of Military Force Since 9/11' by Stephen W. Preston for d di American Society of International Law, Washington, DC wey dey published for di US Department of War, e say di US President take military action.
Di speech highlight say di US bin sign di authorization of di use of military force afta di 9/11 attack.
According to di authorization of di use of military force, e give di President power 'take action to protect di United States against dose wey dey attack' dem. Di authorization of di use of military force dey enacted into law wey later become di 2001 AUMF.
Di researcher add say di authorization for di use of military force wey Congress pass na to 'give di President all di statutory authority wey e need to fight back against' some terrorist organisations and kontri wey dey violent.
According to di US Congress wey institute di authorization of di use of United States Armed Forces against dose wey dey responsible for di 9/11 attacks wey dey launch against di United States, dem give di President certian powers.
"Dat di President dey authorized to use all necessary and appropriate force against dose nations, organizations, or pesins wey e determine say dem plan, authorize, commit, or ai di terrorist attacks wey occur for 11 September, 2001,or harbor such organizations or pesin, in order to prevent any future acts of international terrorism against di United States by such nations, organizations or pesin."
Dis authorization dey in connection wit di September 2001 bombing wey happun, and no line wey really show say e fit affect evri nation.
Howeva, section three of di War Powers Resolution of di US say e require make di President first consult wit Congress bifor dem commit to use di U.S. Armed Forces into any force action abroad.
β16621[Quote]
Some aids wey US dey provide for Nigeria
Wen US President Trump takeova office, one of di policy wey e announce na to cut aids to different kontris through di USAID wey e say e no represent value for money for American taxpayers.
For Nigeria alone, Presidential Emergency Plan for Aids Relief (PEPFAR) don invest more dan $6 billion for di national HIV/AIDS response but Trump announcement bin affect di aid.
Di USAID activities also include to contain di spread of Ebola for Nigeria and Africa at large, including oda diseases wey di kontri dey battle.
Nigeria dey di list of kontris for di world wey dey receive di highest U.S. Foreign Assistance.
Dis foreign aids include health, food production, poverty alleviation, health emergency food assistance, military, amongst odas.
Wetin go happun wen dem declare 'Country of Particular Concern'?
According to di US Department of States, "Country of Particular Concern" (CPC) na designation by di Secretary of State for nation wey engage for severe violations of religious freedom under International Religious Freedom Act (IRFA) of 1998.
"Di US believe say our responsibility na to provide information regarding di status of religious freedom worldwide so dat di international community fit identify and implement solutions to address challenges to religious freedom", US Department of States write for dia website.
According to di US, di International Religious Freedom (IRF) 'require annual review of di status of religious freedom worldwide and di designation of countries wey don "engaged for or tolerate serious violations of religious freedom" during di reporting period.
Dis serious violation fit include torture, bad treatment or punishment, long detention witout charges, abduction or detention, or oda denial of di right to life, liberty, or di security of pesin.
Na under dis category US President Trump bin place Nigeria sake of claim say dem dey kill Christians for Nigeria.
To be 'country of particular concern mean say di US fit impose some economic measures, if dem don use all di non-economic options finish, according to information wey dey available for di US Department of State website.
"Di President authority to designate country of particular concern dey delegated to di Secretary of State."
"For dose cases wia di Secretary of State designate CPC, Congress dey notified, and wia dem don finish di non-economic policy options wey dey designed to bring about stop to di particular serious violations of religious freedom, dem go impose economic measure generally," di website tok.
Wit dis, e mean say di US fit sanction Nigeria or impose some economic measures on di kontri.
β16622[Quote]
Legal expert tok wetin Nigeria fit do
Nigerian lawyer Audu Bulama Bukarti say if Trump attack Nigeria, e become become mandatory for Nigeria to use military and weapons to defend imsef.
Bulama say e dey difficult thing becos Nigeria know say America strong pass am.
"But Nigeria fit rush to di United Nations and ask di council to condemn di incident, and den order di US to leave the country. But e also dey unlikely to happun, since even if di council passes resolution, Trump fit ignore am and dem go get no choice dan to expel am."
But Bulama say e go dey "veri difficult for Trump to attack without Nigeria permission, except for di kain attacks wey dem dey carrying out for Iraq and Syria, sending planes and dropping bombs and running away, and dat kain tin no go produce di desired success. And di American Congress sef go stop am".
In terms of steps wey Nigeria fit take, Bulama list some tins wey dey important.
Warning: "No follow Trump do gbas-gbos for on social media. E fit vex am."
Diplomacy: "Nigeria don use diplomatic channels to educate Trump and di US govment say di security problem for Nigeria dey affect both Muslims and Christians. Statistics, including one wey I find for my PhD research, show say Muslims dey more likely to dey killed in attacks for Nigeria, and dat more mosques dan churches dey targeted."
Education: "Di govment gatz educate Nigerians say if Trump decide to stop providing aid to di country, for example, HIV treatment, no be only Muslims e go affect. Similarly, if arms sales to Nigeria stop, security problems go increase for di country as a whole."
Fighting terrorism wit sincerity: "Although we know say di govment no dey intentionally allow pipo to dey killed, we certainly believe say negligence dey."
β16623[Quote]
Nigerians react as Trump describe Nigeria as 'disgraced country'
Nigerians on social media don react differently to Trump description of Nigeria as 'disgraced country'.
One X user Nwanevu Brian say, "Wetin dey happun for Nigeria no dey disgraceful? Dem use terrorism, nepotism, bribery and corruption to kill di economy."
Anoda user, Sanmi Adekola say why Nigerians go accept dat kain label from Trump.
"I just dey wonder how some pipo and citizens go find am consoling to accept di negative label of dia kontri, as 'DISGRACED COUNTRY'.
Ayo Sogunro say make Nigerians tink well bifor dem accept US to come 'blow up' di area as dem want.
"I understand di instinct of Nigerians wey dey live for affected areas to want di US come in and blow it all up as dem do. But critical thinking suppose exist so dat our feelings no go worsen di outcomes of our decision making process," Sogunro tok.
β16725[Quote]
snca
β16731[Quote]
reca
β16735[Quote]
>>16734>goonhitlerIRL.jpggeg
β16736[Quote]
not even nophono
β16741[Quote]
stop speaking jartynigger language and speak legible understandable English
β16761[Quote]
seet nofonady cayserd arfobrt
β16763[Quote]
Aryan Nigeria
β16766[Quote]
>>16741It's nigerian pidgin
β16784[Quote]
Got scammed by a "nigerian prince" award
β16860[Quote]
Dis shit nophono fit care fan about
β16870[Quote]
>>16736everyphono because us christcacas are gooder