https://www.bbc.com/pidgin/articles/c5y44gg3kekoNigeria don reject claims wey American President Donald Trump allege say widespread killing of Christians dey happun for di kontri as e declare am, "kontri of particular concern".
Di goment tok di denial for statement wey dem drop on Saturday morning.
For di statement, di Minister of Foreign Affairs, Ambassador Yusuf Tuggar tok say oga Trump position no really gel wit wetin dey happun for ground for Nigeria.
E tok say, "we dey stay commited for our ginger to handle di kasala of extremism wey special interests dey fuel wey don help build di decay and division for kontris around di intersecting West African and Sahel regions".
E note say di US don be close ally and say, "di goment of President Bola Ahmed Tinubu go maintain laser focus and steadfast commitment to all partners wey believe in genuine peace, stability, freedom and democracy."
Na on Friday, Trump announce say e don place Nigeria as "kontri of particular concern".
Di US President tok say, "Di United States no fit stand dey look dis kain atrocities as dem dey happun for Nigeria and plenti oda kontris… We tanda ready, willing and able to save our Great Christian population wey dey around di world".
E torchlight say "Christianity dey face existential threat for Nigeria" as im insist say "thousands of Christians don dey killed".
Di US President tok say im don direct some members of Congress wey include, Rep. Riley Moore, and Rep. Tom Cole, plus members of di House Appropraitions Committee to torchlight di mata and give am back wetin dem find.