â„–29064[Quote]
Japan south-western Kyushu region don get more dan 100 aftershocks since one powerful earthquake wit strike on Tuesday, don cause di death of at least 13 pipo.
Many odas dey for "cardiopulmonary arrest" - one term dem dey often use for preliminary reports for Japan bifor dem officially confam say pesin don die.
Inside di very hot weather, rescue teams dey dig through di rubble for one paper factory and one shopping mall for Kumamoto prefecture. Dem dey find survivors wey dey trapped under di buildings.
Di mall bin suffer one explosion within di same hour afta di earthquake happun.
Japanese Prime Minister Sanae Takaichi warn say na "truly a race against time" to rescue dos wey dey trapped.
As she dey give update about di situation dis morning, Prime Minister Sanae Takaichi express her condolences to di families of di pipo wey die and tank emergency services for dia continued efforts.
Di Japan Meteorological Agency (JMA) don urge residents to dey alert for di possibility of strong aftershocks, public broadcaster NHK report.
"For di next week or so, especially di next two to three days, we go like make pipo watch out for potential earthquakes, wit maximum seismic intensity of 7," one JMA official tok.
Tuesday's quake hit the Kumamoto prefecture on Kyushu island at 16:27 local time (07:27 GMT).
One of the worst-hit buildings was the Aeon Mall in Kashima, where a portion of the second floor collapsed.
Thousands dey for evacuation centres and many of dem dey without power.
Rescue operations dey happun for both di Aeon shopping mall wey collapse and Nippon Paper factory for Yatsushiro.
"Although more dan 20 hours don pass since di earthquake, some pipo still dey wey need help," Takaichi tok. "Dis one truly na race against time."